Nigeria goment cut warning afta reports say Ilana Omo Oodua wan start radio station – Information Nigeria Pidgin

Getty Images

Nigeria goment say e no go tolerate di use of any broadcast facility within or outside di kontri to break di unity of Nigerians.

For one statement by di Director General of di National Broadcasting Commission (NBC), Balarabe Shehu Ilelah, e say “Nigeria no need anoda round of headache and disruption by any tribal interest group.”

Di NBC DG dey react to one statement wey bin dey fly upanda say one  group, Ilana Omo Oodua Worldwide go unveil one new radio station wey dem go call Radio Ijangbara on 1 January 2023.

For statement wey di chairman and general secretary of di group sign, dem say di new radio station go dey broadcast from Dubai, United Arab Emirates.     

Di commission say e no go “tolerate di use of any broadcast facility within or outside Nigeria to create disunity among Nigerians and intentionally or odawise mislead pipo to deliberately…



Source link

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.